Dear Royalty,
No vex, but the matter wey I wan talk, English grammar no dey sweet me to put am for paper!
E get one thing wey dey simple to talk, but e hard to do! (THINGS ARE EASIER SAID THAN DONE). E easy to write am, but to put am into action, e get as e be. I beg, it is easy to understand am, but to apply am, no be small thing. It is easy to say, ‘GOD, SEND ME, I will go’ ee (God) don send you now, you disappear.
Abi you don ever reason why some people no fit make some things happen? Like for beginning of the year, e easy to talk say you go go gym at least 20 times before the end of first quarter, but as you dey try am, you go see say, ‘WHO SEND ME?’.
You talk say you no go do fornication again, you even write am for your wall make e be reminder, ‘I no go defile my body.‘ But after small time, you see exchange rate and talk say, ‘even God know say the economy no dey favour us,’ I must make ends meet na. Tomatoes sef don cost, make I chop and enjoy life abeg, no be today Jesus go come!’ E no be like that? Abi? Anaa? E easy to talk than to do.
The promise wey you make before nko? You go dey say sorry for something and still dey do the same thing wey you talk sorry for. Truly, e easier to talk than to do.
Last year, you dey on fire for God, December 31st reach, you talk say, ‘LET ME SEE THE DEVIL THAT GO FIT STOP THIS INTIMACY.’ Now, you don go 2 months without praying like you suppose. E easy to talk than to do! You get?
Howfar the revival wey you talk say you go start for your community? You talk say you go win 15 souls for Jesus? But finally, na still you talk, ‘No be me kee Jesus, souls fit be won, but this fasting I no fit manage. God go understand’
Hehe, dear soldier, e easy to talk than to do. Na my message be that.
Before you talk say you wan do something, make you sit down, think am well before you start. This race we dey run, you fit finish am, but my worry be say, you go finish am well, or you go stop for road?
Think am well o, gospel musician, we dey wait for your song o, abi you don give up because economy hard, dem don lock your voice join?
I no come here to motivate you, na reminder I come give you, say you set goal for beginning of year, abeg, GO BACK NOW AND FINISH THEM! THE MASTER NEEDS YOU! WAKE UP! ABEG, go finish that thing before you set new goals. Quickly, the master dey wait you, this generation dey wait you too.
If you nova finish something, go finish am before you move on. If you promise person something and you never do am, abeg, go do am. Now now o, no waste time.
Hold on, ALAYE! If you dey wan begin revival and you don strong before, na now now be the time to revive your own self! Go pray! Stretch yourself, find your way back. I don write am for English grammar, so you go sabi this part clear. No time for shalaye.
I dey go be that! Me sef get things I for do, I no go lie.

Bye bye
Your blood,
Sharon Paulina Boye
April 3, 2024




Leave a Reply to PaulinaBoye Cancel reply